- Author, Yasmin Rufo
- Role, BBC News
-
31 minutes wey don pass
Quincy Jones, di musician and producer wey work wit Michael Jackson, Frank Sinatra and many odas, don die at di age of 91.
Jones publicist, Arnold Robinson, say im “die peacefully” on Sunday night for im house for Bel Air.
“Tonight, wit full but broken hearts, we must share di news of our father and brother Quincy Jones’ death. And although dis na ogbonge loss for our family, we dey celebrate di great life wey im live and we know say we no go see anoda pesin like am,” di family write for statement.
Jones make name as di producer of Michael Jackson Thriller album.
Im career stretch more dan 75 years. During dat time, im win 28 Grammy awards and Time Magazine name am as one of di most influential jazz musicians of di 20th century.
Im produce and conduct di recording of di 1985 charity record, We Are di World.
Na im also compose di soundtrack to more dan 50 films and TV programmes including Heat of di Night, Di Color Purple and Di Italian Job.
Early on for im career, Jones bin work closely wit Frank Sinatra and re-work Sinatra classic Fly Me To Di Moon im take am from a waltz to a swing.
For di feem film Di Wiz, Jones find imself dey work alongside a 19-year-old Michael Jackson.
Di two work togeda for plenty years and Jones produce albums Off di Wall, Thriller and Bad.