Portugal vs Slovenia: Live updates of di Euro 2024 game

Portugal vs Slovenia: Live updates of di Euro 2024 game
Portugal vs Slovenia: Live updates of di Euro 2024 game

Wia dis foto come from, Getty Images

What do we call this photo, Euro 2024
1 July 2024, 17:18 WHAT

New Informate 2 hours wey don pass

91’ First 15 minutes of extra time son start

Second Half

90+4 End of normal time. Match go enta extra time now.

90+3 Corner kick for Portugal again, Bruno Fernandes play am but e miss Ronaldo head.

90+ 3 Corner for Portugal but Slovenia goalkeeper Oblak clear am from Bruno Fernandes.

91+ 1 Zan Celar of Slovenia dey offside.

90’ Referee add 4 minutes.

89’ Slovenia goalkeeper Oblak no dey give Cristiano Ronaldo space at all, e just dey catch all di ball Ronaldo dey try to score.

88′ Portugal clear Jure Balkovec cross.

86’ Substitution for Slovenia, Peter Stojanovic don comot and Benjamin Verbic don enta.

84’ Slovenia defence dey Odingba as dem do clear all di goal threats from Portugal.

83’ Portugal dey in posssession of di ball wit short shorts passes, dem dey try to drag Slovenia players out.

81’ amino Mendes play one beta cross into do penalty area but opposition defender block am.

78‘ Cristiano Ronaldo try to find di head of im teammate in di box but e over hit di ball. Di ball go out of play. Goal kick for Slovenia.

76’ Substitution for Portugal, Rafael Leao don comot Francisco Conceido don enta.

74’ Substitution for Slovenia, Jan Mlakar don comot and Jan Gorensic replace am. Andraz Sporar don comot and Zan Celar enta for am.

72’ Ronaldo of Portugal play am but e go over di bar. Goal kick for Slovenia.

71’ Foul against Slovenia, freekick for Portugal.

69’ Pelar Stojanovic of Slovenia fail to reach di box as Portugal defence block am.

66. Cristiano Ronaldo dey on a solo run but im no fit create any chance as Slovenia player block am.

65′ Substitution for Portugal Vitinha doesn’t come back and Diogo Jota doesn’t come back.

63’ Joao Cancelo of Portugal cross di ball into di box from near di sideline but e no connect to im players sake of Sloveniantight Defence.

62’ Chance for Slovenia afta Sesko win ball con start counter attack, im

Make good run into di box but no shoot di ball well as e go wide off do right of di empty post.

60’ Slovenia player Adam Cerin volley di ball from outside di box but di ball fly to di sky!

58’ Plenti Pirtugal players balnace for di box dey wait for cross but Bernardo Silva do short pass instead.

57’ Slovenia players block Portugal player Vitinha cross.

55’ Cristiano Ronaldo play do free kick but e land for Oblak, Slovenia goalkeeper Hans.

54’ Adam Cerin cause free kick for Portugal afta im foul im opponent.

52’ Portugal player Vitinha strike di ball towards goal from long range but one Slovenia defender block am.

52’ Ruben Dias criss no dey successfu as Slovenia defenders clear so ball.

51’ Benjamin Sesko of Portugal dey offside wen im dey make one run towards goal.

49’ Adam Caron of Slovenia play short corner kick.

47’ Bernardo Silva of Portugal get beta chance to score inside di box afta ball bounce meet am but im go under so ball and do ball fly over di bar!

47’ Timi Max make one Yeye challeng and Refree blow fou.

46’ Referee Orsato don blow whistle, second half don start.

First Half

45+1 Referee blow whistle for foul against Bruno Fernandes of Portugal.

45’ Referee show 2 mins added time.

43’ One long cross bin meet Bruno Fernandez of Portugal but defenders clear am.

42’ Di two teams just dey hustle for di ball to get possession bifor half time whistle.

41’ Cristiano Ronaldo dey offside

40’ Corner kick for Slovenia l, Adam Caron play am wit short pass.

37’ Freekick for Portugal, Cristiano Ronaldo play am but e go wide towards do right corner of di post.

37’ Yellow card for Zan Karnicnik of Slovenia for foul.

35’ Portugal get anoda corner kick, Vitinha play am but na short corner not in come out from am.

33’ Portugal get free kick, Cristiano Ronaldo play am but e curl pass di bar! E nearly enta net.

32’ Yellow card for Vanjan of Slovenia for foul.

32’ Cristiano Ronaldo of Portugal bin get one ball near di penalty area, e play shot towards goal but goalkeeper of Slovenia save di ball.

30’ Portugal player Ruben Dias go offside

28’ Corner kick for Portugal, Bernardo Silva play am but not in come out.

27’ Portugal get chance for counter attack as Bernardo Silva carry di ball dey run but e no work as dem plan am. Di all no reach Cristiano Ronaldo wey bin dey do box dey wait for di cross.

Wia dis foto come from, Getty Images

What do we call this photo, Cristiano Ronaldo

25’ Joao Palhinha of Portugal commit handball by 24’ Portugal dey try to drag Slovenia players out but e neva work.

22’ Zan Karnicnik of Slovenia bin wan pass one beta ball but Portugal players block am.

20’ Nuno Mendes of Portugal don get small injury as e call for medical help, but I’m don stand up and game don kontinu.

18’ Referee blow whistle for foul against Jan Malakai.

16’ Bruno Fernandes cross ball into di box, but Slovenia defenders no dey sleep at all, dem clear di ball.

14’ Bernardo Silva of Portugal play one beta ball wey dey go di direction Bruno Fernandes for so box area but im no fit reach di pass. Di ball go out of play and na goal kick for Slovenia.

12’ Zan Karnicnik of Slovenia snatch di ball from im opponent leg but refere blow foul.

10’Vitinha play corner kick for Portugal but e land for dia opponent head.

9’ Portugal dey press Slovenia for opening minutes of dis match as Cristiano Ronaldo dey play fancy football wit im dribbling and jogging skills.

8‘ Cristiano Ronaldo try to dribble in opponent but referee ignore di call for foul.

7’ Vitinha of Portugal play one mid-range free kick but di cross no land well.

5’ Ruben Dias of Portugal goal attempt fly wide go di right post. Goal kick for Slovenia.

4’ Bruno Fernandes hit di ball go di penalty area but defender block am.

4’ Nuno Fernandes of Portugal run towards goal but defender clear di ball.

2’ Now now dem don raise flag for Bernardo Silva for offside

1’ Referee Daniele Oresto don blow whistle match don start.

Wia dis foto come from, Getty images

What do we call this photo, Bernando Silva of Portugal bin dey celebrate in first tournament goal for Portugal while Adam Gnezda Cerin don score five goals in 34 games for Slovenia

Portugal and Slovenia go put leg inside one trouser on Monday as di Euro 2024 enta di crucial stages.

Portugal be like they stand a better chance sake of having won the tournament for 2016.

Meanwhile this is the first time Slovenia has reached the Round of 16.

Slovenia Midfielder Adam Gnezda Cerin says Slovenia are not satisfied with reaching the last 16 of Euro 2024.

Slovenia bin play goalless draw against England for dia final Group C match wey help Slovenia qualify as one of di four best third-placed teams.

“Dis na new milestone for di Slovenian national team, for Slovenia in general,” Gnezda Cerin tok.

“We get our goals and I tink say on Monday match go be a beautiful evening for everyone to enjoy sake of say these matches na somtin you dream about as small pikin wey just start to play football.

“We neva finish. We go try to play Monday match at di highest possible level.”

Slovenia, just dey appear for only dia second European Championship, dem drew dia three group matches.

“We don prepare for Portugal,” Gnezda Cerin, wey dey play for Panathinaikos tok.

“Dem be a very, very talented team and dem fit cause problems for us all around di pitch.”

Portugal win Group F even though dem lose 2-0 to Georgia for dia final group game.

Dem don at least reach di quarter-finals for five of dia past six European Championships, including winning di tournament for 2016.

Slovenia win 2-0 wen dem bin jam Portugal for friendly game for March, dem end Portugal run of 11 victories in a row.

Meanwhile, midfielder Bruno Fernandes said Georgia’s defeat to Portugal had put them “on their toes” for the game in Frankfurt.

“We don’t have much time to think about what happened. We have to think about what will happen,” Manchester United’s Fernandes said.

“We respect evri opponent. Dis [Slovenia] team get beta important names, high-quality players – we respect dem well well.

“After the bad results, people have to focus on the negative aspects, but that’s how this football works.”

Line ups

Portugal starting 11: Diogo Costa, Nuno Mendes, Pepe, Ruben Dias, Joao Cancelo,

Ronaldo, …

Slovenia starting 11: J. Oblak, Balkove, J. Bijol, V. Drkušić, Ž. Karničnik, J. Mlakar

T. Elšnik, A. Gnezda Čerin, P. Stojanović, B. Šeškol, A. Šporar

Best of Stats

Portugal bin qualify from di group stage for all dia nine Euro campaigns.

Slovenia and Denmark become di second and third nations to draw all three of dia group stage matches for European Championship. Di first team wey do am na Portugal on dia way to winning di Euro 2016.

Cristiano Ronaldo neva score goal for seven major tournament appearances for Portugal, even though im bin attempt 19 shots for dis run – na di longest time wey im never score.

Slovenia dey average 32% possession for Euro 2024.

Vitinha don complete more line-breaking passes (29) dan any oda Portugal player for Euro 2024.

-

-

PREV Old Masters at Christie’s and Sotheby’s in London
NEXT in demonstration, Spain eliminates Georgia and qualifies for the quarter-finals