New Informate 8 minutes wey don pass
Di Super Eagles of Nigeria chop defeat for dia homeland as Rwanda score two goals to give diasef a chance for di African Cup of Nations (Afcon) qualifiers game.
But di chance of Rwanda no fit shine becos Benin republic don qualify for di Afcon 2025 qualifiers.
Nigeria get 57% ball possession while and Rwanda get 42% ball possession for dis game.
For di 59th minutes, Samuel Chukwueze put in a veri good goal as e drive through into di middle of di Rwanda defenders to put di ball into di net.
Meanwhile, three-time continental champions Nigeria dey among di kontris wey don qualify for di 2025 Afcon.
90+5mins– Samuel Chukwueze with the last minute shot into the goal post
90+3mins- Frank Onyeka wit di move again, but Osimhen dey offside. Referee blow
Good Attempt!!! But di Rwanda goalkeeper stop am. Frank Onyeka dey try small small
90+1mins– Moses Simon wit good dribble.
90mins- Nigeria defender dey give so much space for di Rwanda team but dem no dey ginger at all
89′ SUBSTITUTION- Victor Boniface out, Umar don enta for Nigeria
88mins- Chkwueze playing goo forward ball coordinating di game from di front.
86′ OFFSIDE- Be like say Moses Simon sabi dis pass seehh, good pass to Chukwueze but na off.
85mins- Onyeka wit di fast ball. Nigeria trying to play a calm ball.
He loves Chance Missed!!! Victor Boniface lose dat ball afta a good dribble inside di box 18
82mins– Good set piece by di Rwanda players, good dribble.
80 min– Onyemachi playing from di wing to find Boniface but di rwanda team dey play correct ball as dem don dey ginger
SUBSTITUTION. Victor Osimhen don enta
Rwanda score again. Nshuti Innocent put di ball for back of di net
74mins– The Nigeria team is relaxed for this game. It could be because they’ve qualified
Mutsinzi Ange score for Rwanda. from dt comfortable side and no defender follow am struggle for di ball
70mins- Frank Onyeka wit di ball, good shot but blocked by di defenders. Corner for Nigeria as Chukwueze quickly take am but di keeper push am comot
Good Attempt by Victor Boniface wey still dey find a goal for Nigeria
68′ SUBSTITUTION – Ntwari Fiacre out, Buhake enta for Rwanda goalkeeper
66mins– Ntwari Fiacre, the Rwanda goalkeeper is affected with some kneel injury
62mins– Anoda chance for Nigeria, but Chukwueze nof it catch up wit di ball
61mins– Rwanda don make dia changes as Bosco don comot but dem go still need 2 goals to qualify
59′ Samuel Chukwueze!!!!. dat na veri good goal as Chukwueze drive through into di middle of di Rwanda defenders
Nshuti dey pocketed by captain Troost-Ekong. Innocent
55mins– Maduka Okoye is doing very good goalkeeping today as he catches all the ball that comes his side. The Rwandan team seemed desperate for a goal
50mins- What A Chance!!! Bonifaceeeeeee. What a free header, dat was almost a goal for Nigeria to lead is game. Victor Boniface give one good header from di corner kick wey Moses Simon give
Corner kick for Nigeria. Moses Simon go take am
47mins– Moses Simon neva stop to dey dribble di Rwandans
45mins– The second half has begun and it is still a goalless draw but the Rwanda team wants to make the different so they can fight to qualify
Moses Simon again, e find Victor Boniface… ohhhhh pass blocked.
45mins- Moses Simon dribble from di corner, good crossing into di box 18. Kelechiiiiiiiii, oh good momenbt for di Super Eagles but di shot by Iheanacho dey blocked by di goalkeeper
44mins- Poor tackle by Mugisha Gilbert against Nigeria midfielder
43mins– Corner kick for Rwanda afta Osho give a good tackle to Bizimana Djihad. But di corner no produce any goal.
41mins- Gabriel Osho with good defense against the Rwanda team. Moses Simon with an incredible run from the front but the Rwanda defenders stood firm
Another good tackle by the Nigeria defender.
39mins- Free kick for Rwanda. straight to di hand of Nigeria goalkeeper Maduka Okoye
36mins– Captain Troost-Ekong wit good tackle dia.
30mins– Victor Boniface wey still dey find goal for Nigeria dey confident wit di ball today like always. e carry di ball wit some impressive moves to find goal, but di Rwanda players no shake
25mins– Rwanda goalkeeper Ntwari Fiacre dey active for goalpost today as e dey try help im kontri qualify for di Afcon game in 2025. A win for Rwanda go give dem big hope to qualify
20mins– Di two teams dey play wit confidence to find goal wey go add to dia points for di qualifiers table
Manzi Thierry wit good dribble for di middle but di Nigeria midfielder no gree for am.
14mins– Rwanda go dey hope to find a point but be liek say Super Eagles no go gree even though dem don qualify alreadi
12mins– Ruboneka Bosco carry di ball, move forward to scare di Nigeria defenders but dem block am. Di players dey relaxed
10mins– Corner for Nigeria. Kelechi Iheanacho takes in the corner, but the goalkeeper punches the ball out
9mins– Dele-Bashiru gets the ball. Ohhhhhhh, Alhassan finds the ball, on the counter oooo, but the defender recovers and blocks the pass where he wants to give Boniface.
8mins– Onyedika played with Iheanacho for the side as they tried to free up space to the middle but Alhassan who was given the ball chopped hard tackle
7mins– Rwanda ey find 1 points to qualify. Omborenga dey play good defence for Rwanda as he dey block everi ball wey dey come im way
Ola Aina is not in this game, Ademola Lookman is not in this game too for the sake of going to their club to play a game for the weekend
5mins– Moses simon carry di ball, more forward to give a beautiful crossing but di Rwanda defenders block am. Di ball don go back to Rwanda players
3mins– Nshuti of Rwanda playing good ball for di Nigeria box 18 but di defenders block am from going further to dia goalpost
2mins– Alhassan takes the ball from the middle, passes it to Dele-Bashiru but the shot he fires is blocked
Bright Onyemachi take free kick for Nigeria.
0 min– Di match don start for di Godswill Akpabio stadium for Uyo
Nigeria faces Rwanda in the final round of the 2025 Africa Cup of Nations qualifiers today at the Godswill Akpabio Stadium, Uyo.
Di last time Super Eagles of Nigeria face Rwanda, dem no no see any goal score afta 90 minutes of play wit added time for di 2025 Africa Cup of Nations qualifiers game.
Wit ball possession of 50.9 percent, Nigeria fail to beat Rwanda wey get 49.9 percent for dia Afcon qualifier match for September 2024.
Nigeria: 1. Okoye (GK), 2. Osayi-Samuel, 6. Osho, 13. Onyemaechi, 5. Ekong (C), 20. Onyedika, 10. Dele-Bashiru, 12. Alhassan, 22. Boniface, 14. Iheanacho , 15. Simon
16. Obasogie, 9. Osimhen, 8. Onyeka, 19. Umar, 17. Iwobi, 18. Collins, 4. Ndidi, 11. Chukwueze, 21. Bassey
Rwanda: 1 Ntwari Fiacre (GK), 13 Omborenga Fitina, 3 Imanishimwe Emmanuel, 5 Mutsinzi Ange, 17 Thierry Manzi, 15 Mugisha Bonheur, 4 Bizimana Djihad (C), 7 Ruboneka Bosco, 12 Mugisha Gilbert, 19 Nshuti Innocent, 16 Dushimirimana Olivier
Buhake, Gad, Taiba, Hadji, Jojea, Muhire, Rubangala, Samuel Niyomugabo, Gilbert, Kavita Niyigena
When and how to watch di match
Di match go take place on Monday 18 November, 2024
Time: 5: 00pm Nigeria time
Stadium: Godswill Akpabio Stadium, Uyo.
E never clear who go show am live yet but BBC Pidgin go give una live text updates.
So far, 19 teams don qualify for di 2025 African cup of nations for Morocco.
24 teams go take part for di tournament next year, di next round of qualifying matches dey happun now for November.
Equatorial Guinea, Ivory Coast, Senegal, DR Congo, Algeria, Egypt, Angola, Cameroon, Uganda and host Morocco na part of di countries wey don book dia place for di ogbonge competition afta important wins for match day four
48 national teams across di continent dey take part for dis qualifying campaign.
Three-time continental champions Nigeria dey among di countries wey qualify on Thursday wit one match to go.
Victor Osimhen score for Super Eagles wey come from behind to draw 1-1.
Libya 1-0 win for Rwanda earlier in di day seal Nigeria top-two finish for Group D bifor even dia away game against Benin bin kick off.
As tins be now, Benin, Rwanda and Libya go all go into di final group matches wit a chance of reaching di tournament for Morocco.
Related News :